BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Wetin be Homeland Security wey Tinubu create for Nigeria security architecture
As Homeland Security special adviser, major-general Adeyinka Famadewa go get di responsibility to look into internal security and intelligence for Nigeria.
APC don screen Rivers State Govnor Siminalayi Fubara, but e go get di ticket to contest?
Wit di release of di results of di APC screening exercise wey dey expected, many dey wonder weda di Rivers State Govnor go successfully scale through to get di ticket for a second term and di options let for him.
South Africa declare state of disaster afta days of serious bad weather
Authorities neva give update on di extent of di damages wey di bad weather don cause.
In fotos: Di looks wey steal di night for di AMVCA 2026
From ogbonge red carpet appearances to defining career moments on stage, di ceremony once again prove why di AMVCA remain one of di most prestigious platforms for African entertainment.
AMVCA 2026 full winners list
Di grand finale of di 12th edition of di Africa Magic Viewers Choice Awards (AMVCA) 2026 hapun for Lagos, Nigeria, on May 9, 2026.
Peter Obi set to become NDC presidential candidate as party zone ticket to south
Di NDC for dia national convention also agree say di presidential ticket go return to di North afta just one tenure.
South Africa begin review immigration policy afta Ghana petition to Africa Union on 'xenophobic attacks' against African migrants for di kontri
South Africa Minister of International Relations Ronald Lamola for statement on Friday, 8 May tok say dem find Ghana decision to escalate concerns about irregular migration to di African Union "regrettable".
Sowore para for court, accuse judge of bias afta e reject im 'no case submission'
Justice Mohammed Umar dismiss Sowore no-case submission and ask am to enta im defence for di allegations wey DSS knack am.
How Hisbah gbab youths wey allegedly dey swap wives for Bauchi
Hisba Command for Azare, Katagum Local Govment Area of Bauchi State tok say dem don arrest and detain seven men wey dem suspect say dem dey exchange dia wives among demsefs.
Ginger Me
Special Tori
Jamb set cut-off mark, release new policy for candidates wey wan do courses on education and agriculture
Jamb on Monday say candidates wey go apply for higher institution admission into education programs no go need UTME.
Black Sherif win Ghana music awards artiste for 2026
Black Sherif don win Ghana music awards artiste of di year 2026. Dis be di second time im win di award afta im win am for 2023.
Wetin e mean for your DMs afta IG turn off dia privacy tech?
E2EE na di most secure form of online messaging wey dey allow only di sender and receiver to see messages.
Why South Africa President Cyril Ramaphosa dey face calls to resign
South African opposition leader Julius Malema don call on President Cyril Ramaphosa to resign.
'I pray for one child, I get five' - Woman born quintuplets naturally afta 12 years of trying
One woman give birth to rare quintuplets for Ethiopia Harari Regional state afta di family try and wait for 12 years for a baby.
Four doctors and three nurses sanctioned for medical negligence ova death of hit-and-run accident victim for Ghana
One committee wey investigate di death of hit-and-run accident victim afta three hospitals deny am emergency care don find say medical negligence kill 29-year-old engineer Charles Amissah.
'I marry South African woman, dem dey bully my kids for school' - Nigerian man tok wetin im eye see as protests dey continue
Nigerian-South African Peter Odike wey don dey live for di kontri for more dan 20 years tell BBC say im children dey face bully for school from locals sake of di ongoing xenophobic attack against foreigners.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.














































